Ad

Thursday

Naija na we dey here

Can't stop laughing...
*Na only for Nigeria you go see fish inside "MEAT PIE"..
*Na only for Nigeria we dey count money after we withdraw am from ATM because we no even trust ATM.
*Na only for Nigeria PHCN dey say:-Win a brand new GENERATOR if you pay your NEPA bill...
*Na only for Naija people dey horn for traffic light make e quick change from Red to Green...
*Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke,Recharge Card, Chin chin,Puff puff and beer, Wetin you no see for Naija, you no fit see am anywhere in d world...
*Trust me. Na only 4 naija you go find a graduate of mechanical engineering dey do him NYSC 4 Police station.
*Na only 4 naija you go see one person dey use Bold5, X3, Ipad2 and Nokia N8 all at once while his mother dey sale grandnut For junction 
*Na only 4 naija you go see a graduate of law dey work as generator repairer.
*Na 4 only Naija, you go see mad man dey control traffic, people wey their head correct dey obey...
*Na 4 only Naija, wey you go see the president senior the country himself.
*Na 4 only Naija, you go see native doctor dey use laptop connected with MTN modem. Maybe they are now consulting the spirits online..
*Na only for naija u go see a man selling a book from street to street dat says HOW TO MAKE MONEY WITHOUT STRESS. I wonder why him no read d book. I salute una Nigerians.... Naija no dey carry last..
Na only 4 Naija u go see person read this my joke finish without commenting. lol....

1 comment :